At last: Pogba go play for Man U
– Man U fans don dey dance skelewu as Pogba join their club
– Paul Pogba na 23 year old guyman wey just commot from Juventus come the club
Finally, Paul Pogba wey be ogbonge French player don carry hin bag enter England and the bobo don chop knuckle with Manchester United.
Paul Pogba
PAY ATTENTION: Get the latest sports news on Naij Sports App
The oga dem for Manchester United talk say na 5 year contract na hin Pogba carry hin hand knack put for paper, but dem no gree yarn the amount wey dem take buy the guyman kommot for Juventus.
Even though Manchester United no gree yarn the money wey kommot for their wallet, plenty amebo for obodo oyinbo dey talk say na 89 million pounds na hin carry Pogba enter Old Trafford.
As e kon be now, the money wey Manchester United take buy Pogba don pass the kudi wey Real Madrid take carry Gareth Bale for 2013 as unna go remember say na 85 million pounds na hin Tottenham collect for dem hand.
“Manchester United na better club wey I go take get mouth well well.
“My belle just dey sweet me yafunyafun as I don rejoin this club again, and I no just fit wait make me and the new coachi for the club dey work together,” naso Paul Pogba yarn.
When the contract wey Paul Pogba contract bin kpai that time for 2012, Manchester United no gree give am another contract, and naso dem allow the guy waka go Italy with chinchinlin money.
Oga coachi for Manchester United wey hin name be Jose Mourinho kon yarn say hin belle dey sweet am sake of say Pogba go tap ball for am for the EPL season wey go start next week.
Jose Mourinho
GET for FREE: Get the latest sports news on Naij Sport
“Pogba na better player wey get power and the guy also dey score better goals and I know say hin go helep me well well for this club,” naso oga Mourinho talk.
When Paul Pogba bin dey Mnchester United that time, na only 7 games na hin de small pikin play for them before hin kon carry hin bag kommot.
Well sha, Manchester United don carry one trophy last weekend as dem bilala Leicester City 2-1 for the Community Shield game.
The post At last: Pogba go play for Man U appeared first on Nigeria News today & Breaking news | Read Naij.com 24/7.